Adecanwrite

Adecanwrite

Share

Story telling (fiction & comedy) Video Skits, Content creator, Script writing

24/09/2026

This writing wey ah dey do, na God just use am pity my life. Because who I be? Wey ah go fit write the kind episode stories nd comedy wey ah don write?

Me keh? Son of a carpenter. Na God just use am pity me. E look me give me from small.

Na from small I don sabi this talent. Iffa open my mouth like this, see as lamba go dey pour. And people go drop jaw dey gbadun am like say na gbedu.

Even when i dey college. Thank God, ah get college friend here. But now, ah don put am to writing.

Me, ah come get over 20 thousand people wey dey follow me because of my writing. And you think say na me? Lailai, na God. Na pidgin I still dey use oh.

All i need na to carry my phone, nd ah go lock in. Ah e go just dey drop like say ah dey hear speaking in tongues. And dem no born me well make I twist anything. Iffa try am, anogo fit end am.

God, i thank you. For where I dey with this writing and where you still dey carry me dey go. And thanks to all my followers wey dey support me, especially my subscribers. Where ah for dey see money subscribe to stay online? And to buy snacks and drinks after spending hours typing. God bless you.

And to all of you wey choose me as your writer, God bless.

Now to the story.

My papa dey do birthday. He say we fit invite our friends. I invite my bad boiz dem. Our house get space for backyard.

Na there I dey with my friends. We don buy drinks plenty come. I drink Calypso reach one level, omoh, ah lost begin yarn rubbish oh.

"If your papa go come here now, na wahala oh" One of my friend talk.

"My papa? Wetin he wan do? Come, u no dey respect me oh. Me Agba? Baba, ah be number 2 for Aiyee oh! Na me be man of the house oh. If e see am, he no fit talk anything. If e yarn anyhow, e go kolet oh"

"Your papa go kolet keh"?

"Baba, ah fit use 7 cut him ear. Him dey mental? Afo don do am wetin no good, since. Na my mama ah just dey pity. Because if my papa go drop now, who go dey sample my dear mama"?

Ah see say dem no reply me again.

"Iffa dey para, my papa dey shut up oh. Ah go too wound am. Abeg make we leave that side"

Silent.

"Abeg pour me more jare"

I stretch my cup. Ah come see the hand. Ah ah? This hand come big oh, see hair! Why this person come wear like my papa wristwatch.

As the person dey pour the drink, I raise my head. Na my papa oh.

I do πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡Wha da actual sheeet!

My papa smile "😁😁😁😁😁Number 2 aiyeee"

He pour me finish, drop the bottle. Do πŸ™ŒπŸ™ŒπŸ™ŒEhn!? My chair! Gbefun! Apata-piti!

I hold cup freeze there. The alcohol don clear once!

See all my friends as dem dey look.

Next thing,na so him lyt my face oh!

Omoh...day turn to nyt. My friends exclaim"Yeee!" "Ahhhh!

Β© Adecanwrite

24/09/2026

β„’

Abeg help me share and react on the post.

That night, when the cook serve dinner. Senator Ambali call Isaac to the dining, to eat.

The maid serve them. The house manager, Moon father, stand for one corner as usual. He dey always stand there if Senator Ambali wan chop.

As Isaac pick spoon to eat, the plate move swiftly on its own, off the table, and the food spills on the floor.

Moon father look surprise. He no dey sure of wetin he see. He tell the maids make them clean am up at once and call the cook to come and serve Isaac again.

As he wan eat again, the same thing happen.

"What is going on with you, Isaac? Are you alright"? Senator Ambali ask.

"😒 Yes sir"

"Are you sure"?

"Yes sir"

"Then watch it"

"Yes sir"

Isaac eyes jam Moon father own..
***************
That night, Isaac dream. He see senator Ambali step out of him car with him entourages and someone shoot him in the head. He wake up at once. Fear catch am.

"Why does he care so much about Senator Ambali?"

E be like say, na wetin you give am you go get in return.

Show him love, you get love. Show him wickedness and you will feel it.
**********
The next day for skool, Isaac see Moon and Hakeem together again. He no believe am. Sebi this guy promise to leave Moon alone. Anger fill his heart.

After school,he follow them.

Isaac don dey carried away, as he dey look Hakeem and Moon, walking hand in hand. Suddenly, he feel handkerchief for him nose. Just once wey he inhale, he don lose consciousness.

When he open him eyes, he dey sit on a chair for one uncompleted building. Him hands and legs don dey tied to the chair.

Two men stand for him front. They hold knife for hand. Dem dey look am.

"What is going on? Untie me"!

Hakeem and Moon father walk to Isaac, from behind. Dem dey smile.

"Welcome back,boy" Moon father talk.

Isaac no dey too surprise.

""Wetin you want with my daughter"? He ask Isaac.

"Ah no get intention to hurt your daughter. I love her and...and I wan prove to her, that I truly love her. Please let me go"

"She no tell you, say she no want you"?

"She tell me. But i believe say she fit change her mind" Isaac respond.

"Well, sorry to disappoint you. She no fit change her mind. Na Hakeem my dawta go marry. I want to be the inlaw to one of the most recognized senator in the country. And you wan spoil my plan"

"You are just after his money! Both of you! What kind of a son are you"?Isaac ask Hakeem.

"A prodigal son!" Hakeem reply. "Just like he use to call me. He no like me . Even my mama no like me. She barely come around to see me. She don abandon me. I never enjoy him as a father for once. Well, the time will come...after I marry Moon....He no even buy the house in our name! Nobody know about the house except me and my mother. So, once I marry Moon, ah go tell am, make he make me the outright owner of the house, because I will tell him about the money"

Isaac look confuse.

"Oh...okay. Let me tell you wetin you no know. Senator Ambali loot a lot of money from politics. And guess where e dey keep the money? My daughter bank accounts"

"When he marry my daughter, my daughter go dey bear Ambali. Then we go fit talk about the monies in her bank accounts... and the house" Moon father talk.

"Yes, and once my father know say I dey marry her, he go treat me better because he know say ah go don know about the money. Simple business, you know"? Hakeem added.

" And now, you dey stand on our way, with the lovey lovey wey you dey do with my dawta"

"Does Moon knows about this"? Isaac ask.

"(Chuckle) Why not? You know, I dey see the way you use to look at her since both of you dey young. When i see say my dawta don dey feel the same way about you, I change her mind. I tell her about how you kill your family and how the senator help you. She hate you after that night"

Isaac no talk anything. Although,Moon father think say na lie him tell Moon to change her mind. But na true and na only him, know say na true.

"I want a clean job" Moon father tell the men. Him and Hakeem begin walk away.

One of the men bring out a pistol, nd shoot Isaac on the chest. He tumble with the chair, land for ground.

Blood dey gulp from Isaac chest as e dey for ground. The man return the pistol inside his pocket. He and the other walk to Isaac and untie him. Then they begin to remove him clothes. They wan cut him body to pieces for easy disposal.

All of a sudden, Isaac gasp for long. And then sit up like a vampire. The men jump back with fear. Az how!? Isaac reach for one of their matchete and hack one of the men on the forehead. The man fall on his back with the machete stuck to his forehead.

Isaac stand up quickly and the other man attack him. He begin punch Isaac aggressively towards the window.

They both hit the window wey no get burglary nor cover, nd they both fall over.

They fall from the fifth floor of the uncompleted building and land on the concrete floor, in front of Hakeem nd Moon father, wey just dey walk out of the building.

They stop immeadiately with their jaws dropped.

They walk close to their mutilated body.

Isaac begin to move with the sounds of move cracking....

To be continued...

I thank ALMIGHTY GOD for giving me the gift of writing.

Β© Adecanwrite

24/09/2026

You people ehn, I upload picture, you turn am to sticker send to me. You come tag me "Sisicanwrite Temubaby Easy buy mannequin"

Is this fair?

23/09/2026

β€ŽMy papa dey work for one site. Na me dey supply am. At a time, some items finish. My papa gimme money make ai run go nearest Sawmill, go buy them, from him friend.
β€Ž
β€Ž"Tack nail one kg"
β€Ž
β€Ž"sand paper, 3"
β€Ž
β€Ž"tornado nail 2kg
β€Ž
β€Ž"tye rod 3pieces"
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽHe warn me say iffa buy nonsense come, he go finish me.
β€Ž

β€Ž
β€ŽI know myself, ah fit forget. So, as I collect the money like this, ah begin run go, dey use am sing "
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽπŸŽΆ "Tack nail one kg 🎢
β€Ž
β€ŽπŸŽΆSand paper, 3🎢
β€Ž
β€ŽπŸŽΆtornado nail 2kg 🎢
β€Ž
β€ŽπŸŽΆtye rod 3 pieces 🎢
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽAs I reach one corner, naso ah see crowd. Wetin apun? Me wey like amebo korikori..Naso ah manage reach front, see say na two women dey fyt. Dem don seperate them taya dem no hear. They don naked themselves. See abbobies and unshaved kponmo everywhere.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽOmoh, ah stand dey look oh. Especially when they nak themselves for ground, open leg waahhh, bobby go go East, come West. Wha a DSTV premium sheeet!
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽAh don dey forget myself. Something come remind me say my papa dey wait for me.
β€Ž

β€Ž
β€ŽNaso I continue to dey jog go. Ah wan resume my song...otilo.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽAh first stop.
β€Ž

β€Ž
β€Ž"Tacky...Tacka?yeee...wah da sheet!...Takunlah!...Takunlah..1... okay...second one.......Sanda...Plier...Sende pempe...2...
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽThat number three vanish completely from my head. I just dey think...."Tomato..?no...tosabo..? Potato...? 4...why not...ty-nut...
β€Ž
β€ŽπŸŽΆTakunlah🎢
β€Ž
β€ŽπŸŽΆSende pempe.
β€Ž
β€ŽπŸŽΆTosabo potato 🎢
β€Ž
β€ŽπŸŽΆty nut 🎢
β€Ž
β€Ž
β€ŽNaso I carry am reach my papa friend shop.
β€Ž
β€Ž
β€Ž"Good afternoon sir"
β€Ž
β€Ž
β€Ž"Dapo awayu"?
β€Ž
β€Ž
β€Ž"Fine sir...my daddy say ashu buy
β€Ž

β€Ž"Takunlah 1kg"
β€Ž
β€Ž"Sende pempe 33"
β€Ž
β€Ž"tosabo potato 2"
β€Ž
β€Ž"ty-nut..tiwi(3)
β€Ž
β€Ž
β€ŽMy papa friend do πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡
β€Ž
β€Ž
β€ŽI thank ALMIGHTY GOD for giving me the gift of writing
β€Ž
β€ŽΒ© Adecanwrite
β€Ž
β€Ž
β€Ž

23/09/2026

β„’
Isaac wait till night come. He sneak out of the mansion.

He wear cover head sweater. He put the well sharpened machete for armpit. He put him hands inside the sweater pocket as he walk along the road.

Isaac arrive at the house. Nobody dey for front of the house. But the house geh fence.

Isaac climb the fence, and jump into the compound. As e land, dog begin bark.

Suddenly, Isaac see say light bulbs dey turn on. Na sign say residents don suspect say e be like say pesin don enter the compound. He quick hide for the back of drum of water wey dey one corner.

He dey there for like ten minutes. He no move. The lights go off and the dog no bark again.

Isaac tiptoe to the entrance door. He see say na iron So, no way to break in.

He return home.

The next day, Isaac put the machete for him skool bag, go skool. After he finish lecture, he wait for Moon and her boyfriend. Luckily, Moon no follow her boyfriend go house. So, isaac follow am quietly.

The guy stop for T-junction, make call. He come wait. After some minutes, a lady walk to him. They hug, kiss, begin walk home togeda.

"😑 So, his hediot dey even cheat on Moon" he talk to himself.

Isaac let them walk into compound. He wait.

After few minutes, he first shadow. When he see say coast don clear, he approach he building. He jump the fence into the compound. The dog begin bark again. This time, he no send the dog. He just dey approach the door and the dog dey bark angrily.

Suddenly, the door open and the guy walk out of the entrance door. He shock when he see isaac.

"Who are you? Wetin you want"? The guy ask.

"Can you please leave Moon alone? I love her". Isaac respond.

" What?" The guy mutters.

"I know say you dey see another gurl. She even dey inside your room like this. So, abeg, leave her alone"

"Bro, she know say ah geht someone else and she no care, as long as she have me. Shey you understand...? How you take enter sef"?

"Abeg, help me tell her make she leave you, so that ah go fit get chance with her...abeg 😒"

"You smoke? Guy, u come here come dey whine. Ah no dey leave Moon. And again, u jump fence enter my compound. You be thief! Ah go call police!"

The guy enter house. As e wan bang the door,Isaac push the door back. The door hit the guy unexpectedly and he fall. Isaac enter begin open bag. The guy stand up begin run up the stairs. Isaac run after him.

The guy run enter living room, run pass the gurl, enter one room, lock the door.

The gurl jump and scream with fear wen Isaac run into the living room with machete.

"Where is he"? Isaac ask the gurl.

The girl point hand.

"Open the door or else ah go kill her"

"Leave or else ah go call police"! The guy scream from inside the room.

Isaac notice two phones for table.

"You dey bluff. How you wan call police when your phones dey here"?

" 😭What is going on"? The girl ask.

"Tell your boyfriend to come out of the room,now,or else ah go kill you"

"Hakeem,.. 😭😭..Hakeem". The girl dey beg.

Isaac walk close to the girl with the machete for hand.

"Open the door or else ah go cut off her head nd leave. Nobody go believe you say no be you do am. Ah go count to three..."

"😭 😭 Hakeeem .." The girl beg again.

"One!....two!....

"Ah dey come! Ah go open the door"

Door lock turn and Hakeem walk out of the room with him hands raised.

"😒 Abeg, no hurt her. Ah promise, ah go leave Moon alone. I promise"

"Swearr with your life"

" I swearr! I will never come close to her again".

" Thank you"

Isaac put the matchete back inside him bag.

"Ah dey very sorry for the disturbance" he talk and walk out of the room.

"Give me my phone! Am calling my dad! Before he walks far!" Hakeem tell the gurl.

Isaac hear. He halt, turn and dash back into the room. He open the bag at once, bring out the machete again.

"No! No! Please!" Hakeem beg.

"Who you you wan call"?!!πŸ₯΅. Isaac ask angrily. Kneel down there!"

Hakeem and the girl obey.

" My dad!...please!...

"Who is he? police officer"?!

"No!..no!...please"!

" Then who is he?

Silence...

"I said, Who is he?!!!!

"Senator...

"He no get name!"? Ah go cut you!"

"Senator Ambali!!

Isaac drop him jaw.

"What?! Liar!! Isaac yell.

"Ah swear!" Hakeem points to the portrait on the wall.

Isaac stare at it with disbelief.

"Him family dey live for Europe. How come"?

"😒 He no marry my mama. My mama na him side chick"

" What?! Does she know"?

" Who?!

"Moon!! She know who your papa be?

"No..."!

"Senator know say you dey date her?

" No!"

"If you call him, I will kill you"! Isaac talk.

" I wouldn't!

"Stay away from her!

" I will"!

Isaac return the machete inside his bag and storm out of the house.
***********
"😒 Isaac come here"! Hakeem yell into the phone receiver.

"What! How? Wetin him dey find"?

"He is crazy about your daughter. He come threaten me say make i no see her again"

"Are you serious"?

" I am. He is dangerous. He fit scatter our plan" Isaac reply.Wetin you suggest make we do"? He added.

" I will handle him, you wouldn't hear from him again"

" Alright sir"

Moon's father drop the call. He look angry...

I thank ALMIGHTY GOD for giving me the gift of writing.

Β© Adecanwrite

Photos from Adecanwrite's post 22/09/2026

My parent try to born girl, buh girl no come. E dey always pain my mama. I assure her say, no worry.

Ah dey always try my best to fill in the shoe of a gurl for her. If she buy new clothe. Na me dey test am first. Once e fit me, e go fit her.

If e no fit me, e no go fit her, so she go return am collect another one or make she amend am..

An no know who go dey help her test run her clothes for her now. I miss her kpa. Ah don go Libya by road 🀣🀣🀣🀣

So, incase u no know, ah dey do modelling for women wear.

Talk anything wey dey your mind. Feel free, na you sabi.

22/09/2026

β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€Žβ„’
β€Ž
β€ŽPolice rush Isaac to the hospital. Days later when he don dey conscious, police ask am questions about everything wey happen at the house.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽIsaac tell the police how Mr jeffery arrive at he house that evening, and e dey rage with intense anger. Say he first begin beat him wife. And when the children wan try help their mother, he attack them, begin kill them.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽIsaac also tell police say Mr jeffery for don kill am if the police no quick come that day.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽNeighbors also claim say dem see Mr Jeffery when they peep from their window, after they hear gunshots, say him dey beat Isaac like say he be animal and him dey drag am for ground, back into the house, after he don try to kill him with a gun but he no succeed.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽThe police believe the stories wey later go viral.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽIsaac spend about a month at the hospital. After that, he return to the orphanage. But because of him story, families dey fyt to adopt Isaac. They wan show am care, and give him a new life, say because he don go tru huge trauma. And again, he get good grades for skool.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽNa one politician, Senator Ambali, na him later adopt Isaac.
β€Ž
β€Ž
β€ŽIsaac na the only child wey dey senator Ambali mansion. The mansion get many workers, cook oh, drivers oh, gardeners oh, name them.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽSenator Ambali wife and children dey for Europe. Na there dem dey live. Senator Ambali sef no dey sleep for the mansion everytime. He employ personal maid for Isaac. The job of that maid na to look after Isaac 24/7.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽIsaac enjoy him new life. Na everything wey e ever dream of, na him he get.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽFor 8 years, Isaac dey that house. The mansion get manager. The name of the mansion manager na Mr. Hamzat. Mr. Hamzat and him dawta dey live for the mansion. Senator Ambali give them their own quarters.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽIsaac love Mr Hamzat dawta, Moon. He dey crazily in love with her. Moon na the only child of her father. Her mama don dye and since then Mr. Hamzat no remarry. Isaac meet them for the mansion.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽIsaac dey obsessed with Moon. He no fit go one day make he no see Moon, he go sick. Moon on the other hand no like Isaac. But them be friends, just friends.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽMon na very beautiful, decent and intelligent girl. Na as she dey grow she dey get better in everything. And na everyday, Isaac love for Moon dey grow.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽMoon first Isaac finish college. So she dey 200L before Isaac enter higher institution.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽSince Moon enter higher institution, she withdraw completely from Isaac. But Isaac no give up on her. When he get admission into her skool, he happy dye. Na wetin he dey find be that. Na because of her, he apply for the school sef. He believe say as he don dey same school with her, she go give her time, and them go spend more time together.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽMoon no talk to Isaac in school. She go do like say she no see am. And if Isaac make move to talk to her, she go shun Isaac.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽIsaac soon make friends, Henry and Alice. Alice na one beautiful, smart girl, wey dey crush on Isaac, but Isaac no even see her at all. He just like her as a friend, nothing more. Na only Moon he want.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽHenry know say Isaac dey crazily in love with Moon, and he know say Moon don get who she dey date. But he no know how to tell him friend make e no break him heart.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽBut one day, he decide to tell him, maybe he go even give up on the girl. He tell Isaac about Moon relationship with a 300L student. Isaac say na lie. Henry say na true, say dem even get spot where dem dey meet, for inside campus. Isaac beg Henry to take him there say him promise say he no go misbehave.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽWhen they reach, Isaac use him korokoro eyes see say na true. Chaeee! Him eyes red. Moon even follow the guy go him house.
β€Ž
β€Ž
β€ŽNa hours after Isaac don reach house, Moon arrive. Ahh! Isaac dey imagine many things. So, this guy dey kulumbele the babe wey him dey dye for, anyhow. He no fit sleep that night.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽDays later, Isaac summon courage. He think am say maybe make him try make move. After class, he begin find Moon, he no see her. He go auz go wait for her. When Moon come dey by the pool later that day, Isaac go meet her. Isaac wan craze. See skin, see beauty! wha da sheeet. Him poko vibrate!
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€Ž"Moon, ah don love you since the very first day wey I see you, since when we be kids. Please, give me a chance to show you that I can make you happy" Isaac ask Moon out.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€Ž"I have someone I am in love with. And you no be my type" Moon reply him. She no even look at him. She dey press phone.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽThat moment, something brew inside him again. Same thing that brew inside him at the Jeffery's resident. He imagine himself pushing Moon into the water, and then pin her head under the water, till she go dye.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€Ž"Can you please excuse me now? Moon talk.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽFrom that moment, Isaac hate Moon. Him anger dey boil more anytime he see her with her boyfriend.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽHenry advise Isaac make e forget about Moon and look at Alice wey dey dye for am. "Can't you see? this babe is crazy about you. You no even see her, ehn!? You just dey vess up and down, dey disturb yourself over a girl whey no even send you. She no want you, fine. Move on!
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽIsaac no see himself moving on. Na she he want. He no vess for her again. One day, he sneak after Moon and her boyfriend. He find out where the guy dey live.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽHe go house go sharpen cutlass wey him see for garden...
β€Ž
β€Ž
β€ŽTo be continued...
β€Ž
β€Ž
β€ŽI thank ALMIGHTY GOD for giving me the gift of writing.

Β© Adecanwrite
β€Ž
β€Ž
β€Ž

21/09/2026

THE COOK

If you dey chop pepper, no read oh.

My papa invite some members of the prayer warrior come house, to entertain them after a program. My mama come dey prepare rice and stew for them.

So, as she dey prepare the stew, my papa call my mama say dem wan pray for her. She come quickly temme say make I use the small plastic spoon, take salt, make e reach half, make I put for the stew.

Mistake wey I do be say, I carry the container close to the soup. As I wan remove salt with the spoon, the container just drop for my hand, turn upside down, face the stew.

I fess freeze. I quickly remove the container, but about 30kg of salt don enter the soup, even come outside like mountain inside the soup. I quickly pack some comot, but plenty don melt and sink inside the soup. I quickly add small water, turn am. When I taste am...oh Lord Jesus! E be like make pesin dey chew raw salt.

I begin shake. This one na big disgrace for the family. How my mama wan tell my papa say soup never ready?

Naso my mama rush back say oya say she and one of the men wan get something for bustop, make I serve them, put one meat one fish for each person, make I do fast.

JESUS! How I wan tell my mama? She go kee me.

Naso I call my junior brother join body so that if complain reach my papa, we go kolet wotowoto togeda.

Na my brother dey put rice, na me put stew.

We serve everybody round for dining table. Me I know say dem no fit chop until dem pray. So, I set everything before them, put the drinks. My papa sit for sofa dey discuss with them, na there we serve my papa.

Naso I tell my brother say, "brother, run for your life" He say why? I say just run for your life. He no answer, he still go sit beside my papa. He wan do atenu, say our papa go remain for am.

Me, I run for my life, go backyard go stand for sitting room window.

Dem come pray.

"In Jesus name we pray...AMEN!"

"Ah! Pastor Peter, this looks sumptuous! Thank you for hosting us" one of them talk, dey smile.

For my mind "you never see anything"

My papa say "Don't mention...thank God"

I hear sound of spoon wey dey touch plate..."kraun kraun" and happy gisting. I know say dem dey mix...I close my eyes.

Suddenly, Silence....I open my eyes. I know say e don red.

Na my papa fess shout "Arrrrwww.." He forget say he be Pastor. The salt enter him Medulla oblongata, baba shout "Ayilala oh!...Awwwwrrrr!

Next person shout "Obara Jesus! Awwrrrrrrrr!

Another person "Alagbawi Eda oh!awwwrrrrrr!

The person enter spiritual realm "Awwwwww....Reketebo!!awwrrrrrr!

My brother wey wan do atenu, go dey ask fuulish question "Daddy is it sweet?

See slap like gunshot.

Kpos!!!

He just make sound like puppy wey dey cry for food and I hear sound say something land for centre table...grragbakah...Gbush!

Na the pesin wey murmur "ALLAHU-AKBAR!! after that slap na him off me kpatakpata.

I know say I don dye. Naso I tear run. As I reach gate, I jam my mama and the man wey dem comot togeda.

She see say I dey sweat and I dey panic. She say wetin happen, I say nothing. She say na lie, naso she grab me for shirt, dey drag me inside. Naso I begin beg.

My papa begin shout my name from inside. We come jam for parlor door. As he say make e use vess punch me for face like this, naso I dodge am. My papa panelbeat the man punch for jaw. Naso the man stagger go back sit down for floor. As I see blood and see my papa put hand for waist open mouth, naso I p*k race because I know say it is finished.

Report reach headquarters say my papa wan kee them. He give them salt make dem chop still come comot pesin teeth. Dem suspend my papa oh.

But, my papa suspend my good health oh. He panelbeat my body with koboko wey be say the mark turn to crawcraw. I even geh psychological issue. Na small e remain the beating for make me craze kpatakpata.

I go just wake up for midnight dey shout "daddy abeg...papa abeg" dey scratch body like say I use body rub werepe leaf.

I thank ALMIGHTY GOD for giving me the gift of writing.

Β© Adecanwrite

21/09/2026

β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽThank you all for your comments, reactions and shares. God bless you.
β€Ž
β€Ž
β€ŽIssac na 10 years old when he arrive at the Jeffery's house. Na him be the oldest among the kids wey dey that house.
β€Ž
β€Ž
β€ŽE no take time at all before Mr and Mrs Jeffery fall in love with Isaac. He dey very smart, intelligent, quiet and well behaved.
β€Ž
β€Ž
β€ŽMr and Mrs Jeffery don born three girls before, Paulina, Beauty and Lizzy. They adopt Isaac because they want boi and Mrs Jeffery no ready to born tru Caesarian operation again.
β€Ž
β€Ž
β€ŽThe girls begin hate Isaac, because their parents don too focus on him.
β€Ž
β€Ž
β€ŽAt the end of the school term, Isaac top his class. The gap wey dey between him and others in that class no be here. Even the school celebrate him..Mr and Mrs Jeffery throw mini party for Isaac because of the excellent performance. They invite their children's friend from around and from skool.
β€Ž
β€Ž
β€ŽIsaac no get close relationship with any of the friends wey come.
β€Ž
β€Ž
β€ŽAs the party dey go on, Isaac sisters gang up with three other girls. Them begin use Isaac play, dey laff am say e be adopted child wey no get parent. When Isaac no fit take am again, he walk inside and lock himself up inside his room. He begin cry.
β€Ž
β€Ž
β€ŽMr and Mrs Jeffery no know anything about everything wey apun at the party. Isaac no tell them.
β€Ž
β€Ž
β€ŽIsaac sisters no stop to dey taunt Isaac, since that day, because dem see it as the only way to make him feel bad. But everytime, he dey always walk away..
β€Ž
β€Ž
β€ŽOne evening, Isaac dey play with the family dog, for garden. Paulina friend, Bella, also enter the garden. She tell Isaac say she wan play with the family dog. Isaac refuse.
β€Ž
β€Ž
β€ŽBella enter house, go tell Isaac sisters. They all come outside to question Isaac. Isaac no talk. Paulina give Isaac one hot slap. The other girls also punch him and call him names.
β€Ž
β€Ž
β€ŽWhen Mr and Mrs Jeffery return, them see say Isaac no come out of him room, to greet them, as usual. Mrs Jeffery suspect say something don happen. She ask the girls but dem no talk anything.
β€Ž
β€Ž
β€ŽMr and Mrs Jeffery come knock Isaac door, tell am make he come outside. When he come out, they see bruises all over his face and hands. They did not even ask him what happened. They already know.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽMr and Mrs Jeffery punish the girls severely and ask them to apologize to Isaac.
β€Ž
β€Ž
β€ŽNa wetin come make the girls hate Isaac the more, be that.
β€Ž
β€Ž
β€ŽOne evening, Isaac sit for garden when the family dog begin bark at him for no reason. He pursue the dog but e no go. The barking come dey high and the dog dey near am.
β€Ž
β€Ž
β€ŽSomething brew inside Isaac. He stand up. The dog jump on him and Isaac grab it by the head, like say he grab rat.
β€Ž
β€Ž
β€Ž"😑 So, you sef hate me!!?! Isaac yell.
β€Ž
β€Ž
β€ŽHe tear the dog mouth into two in seconds and throw the body on the ground
β€Ž
β€Ž
β€ŽHim body calm. Him eyes clear. He don kill family dog. Omoh see gobe! He begin think of wetin him go do...@11 years old.
β€Ž
β€Ž
β€ŽHe sneak enter house. Everybody dey watch TV n e dey loud. He carry shovel and sneak out.
β€Ž
β€Ž
β€ŽHe bury the dog inside a shallow grave, at the back of the house.
β€Ž
β€Ž
β€ŽLater that day, dem begin find the dog. Isaac sef join them, to search for the dog.
β€Ž
β€Ž
β€ŽA day pass by and nobody see the dog. The Jeffery's begin think say person don steal the dog. Not until two days later when Mr Jeffery go to the back of the house to check the Dstv dish, and notice a fresh dug out sand. He become curious. He go carry shovel inside house n dig up the place. See smell. He see the dog. Right away, he know say na Isaac. The girls no fit do this one.
β€Ž
β€Ž
β€ŽMr and Mrs Jeffery punish Isaac well well. And since then, their relationship break down. How 11 years old boi go kill dog, bury am? and he no even gree tell them wetin the dog do or how it happened.
β€Ž
β€Ž
β€ŽIsaac sisters like wetin dey happen. They like as attention don return to them. And them dey ready to do anything in their power for things to remain like that.
β€Ž
β€Ž
β€ŽWhen their parent no dey, dem no dey give Isaac food, because na only Paulina fit serve good if their mama no dey, and them notice say unlike before, their parents no care about him again... since the dog incident.
β€Ž
β€Ž
β€ŽOne afternoon, hunger waya Isaac sotey, he no fit bear am anymore. He sneak enter kitchen, carry food. He sit for one corner of the kitchen dey rush the food.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽHe no know say him sisters dey watch am. Naso dem enter kitchen.
β€Ž
β€Ž
β€Ž"How dare you touch the food without telling me"? Paulina queried.
β€Ž
β€Ž
β€Ž"😒 You no give me food and I dey hungry"
β€Ž
β€Ž
β€ŽPaulina hiss, walk to Isaac n kick the plate away. The food pour for floor.
β€Ž
β€Ž
β€ŽSomething brew in him. Just like the day he kill the dog. He stand.
β€Ž
β€Ž
β€Ž"You shouldn't have done that 😑" Isaac talk.
β€Ž
β€Ž
β€ŽPaulina and the girls laff. Then Paulina slap Isaac again. They believe say him dey helpless.
β€Ž
β€Ž
β€Ž"No ever talk back at me again. You are not a part of this family. Go look for your mother! Your mother abandon you! Your mother is a whoooore!' Paulina, a nawty 10 years old girl, talk at Isaac, like an adult.
β€Ž
β€Ž
β€Ž"😑 😑 😑 😑 😑 "
β€Ž
β€Ž
β€ŽSomething possess Isaac and he move like robot. He carry tumbler, and smash it on Paulina head. Paulina go down straight, in an awkward manner.
β€Ž
β€Ž
β€ŽBeauty and Lizzy scream with fear. Instead make them run away. They run at Isaac. Isaac carry a part of the broken tumbler wey dey for ground. He grab Beauty and begin to stab the left side of the neck. Lizzy dey Isaac back dey beat am. She no know wetin dey apun for front.
β€Ž
β€Ž
β€ŽAs Isaac dey stab Beauty non stop, blood na water oh, wah da sheet!All him face, na blood. Lizzy come begin see blood for floor. A 7 years old girl. She fess leave Isaac turn. Na that time Isaac release Beauty. Beauty land for ground like sack of sugar. Lizzy scream with the whole of her might. She no fit move. She just dey shake, dey cry.
β€Ž
β€Ž
β€Ž"😭 😭 😭 pleas....pleas...please...." Lizzy dey stammer, dey shake.
β€Ž
β€Ž
β€ŽShe turn at once and start to run towards the door, screaming. Isaac reach him like flash and grab her. He fling her trowey like say she be parker. Lizzy hit the kitchen cabinet with a thud. She feel pain but she no care. She wan escape. She get up quickly snd begin to throw things at Isaac.
β€Ž
β€Ž
β€ŽFinally she pick a knife. The knife sef big pass her hand.
β€Ž
β€Ž
β€ŽCar horn. Their parents don come. Lizzy begin scream, "Help! mummy! daddy!"
β€Ž
β€Ž
β€ŽIsaac attack. Before she raise the knife, Isaac don reach her. He grab her neck and press it hard. He choke her n she drop the knife. She begin beat Isaac to free herself.
β€Ž
β€Ž
β€ŽShe taya. Her eyes turn red. She begin jerk. Isaac no leave her till her heart stop.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€Ž"Where is everyone"? Mrs Jeffrey ask as she enter house.
β€Ž
β€Ž
β€ŽIsaac hear. He tiptoe to the back of the kitchen door. He think of wetin him go do. He see pestle for back of door and carry it. Him sef wonder aw him get strength to carry the pestle. He wait.
β€Ž
β€Ž
β€ŽThe kitchen door open. Mrs Jeffrey enter. She see the girls and scream. She run to them and kneel. She begin weep. Isaac no move. He know say he fit handle Mrs Jeffery anytime. Na Mr Jeffrey matter.
β€Ž
β€Ž
β€ŽMr Isaac run in. He hear the scream. He no believe him eyes. He put hand for head. Isaac sneak on him and hit him on the knee, with the pestle. Mr Jeffery groan loudly, come stagger go front. Isaac wan hit am again. He dodge and kick Isaac in the stomach with the other leg. Isaac fly, hit back of head for wall, land for ground, faint.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽMr Jeffery run to the girls. He begin cry with him wife wen he realize say them don dye.
β€Ž
β€Ž
β€ŽAnger fill Mr Jeffrey soul. He get up and run out of the kitchen. He run to their room to get his pistol. When he return to the kitchen, Isaac don go. Mrs Jeffery lie for floor dey jerk. Broken tumbler dey stuck for side of her neck. Blood dey gush.
β€Ž
β€Ž
β€ŽMr Jeffery cry and scream loudly.
β€Ž
β€Ž
β€ŽHe race out of the kitchen with the pistol, and begin to search for Isaac. Isaac don run enter their garden, go hide for back of tree. He for leave the house kpatakpata, but gate don lock.
β€Ž
β€Ž
β€ŽMr Jeffery find everywhere inside house, for Isaac, he no see am. He enter garden dey find am. Him hand dey the guun trigger.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽIsaac make move. Mr Jeffery fire. He miss. Isaac run and hide behind the second tree. Mr Jeffery fires at the tree.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽNeighbors call police asap.
β€Ž
β€ŽMr Jeffery bullet finish. He throw the gun down and run to the tree. Isaac pick race. He pursue him and catch him in no time. He carry him and throw him to the ground with full force. He sit on Isaac, begin punch him face non-stop.
β€Ž
β€Ž
β€ŽHe break Isaac nose, jaw, even pluck him teeth, all with punches. Isaac no know where him dey again. Mr Jeffery stand, and begin to drag Isaac back into the house. Blood dey draw line for ground as he dey drag Isaac go. When they reach inside the living room. He dey look the body, dey think of wetin him fit do, to him. He dey boil with anger. 11, years old boi don wipe out him family. A boy wey him use him money bring under him roof, dey cater for.
β€Ž
β€Ž
β€ŽPolice arrive, jump fence enter, as neighbors dey shout for them say the man wan kill him son.
β€Ž
β€Ž
β€ŽMr Jeffery remember the pestle. He enter kitchen go carry am. As he return, wey him raise the pestle, to scatter Isaac head, police enter.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€Ž"Don't move! Police!
β€Ž
β€Ž
β€ŽMr jeffery stop. And then Isaac open his eyes, look at Mr Jeffery,and smile at him.
β€Ž
β€Ž
β€Ž"😑 ahhhhhh!" Mr Jeffery anger boil again. He forget the warning and move. He wan break Isaac head.
β€Ž
β€Ž
β€Ž"πŸ”₯pha!"
β€Ž
β€Ž
β€ŽPolice shoot Mr Jeffery.
β€Ž
β€Ž
β€ŽTo be continued...
β€Ž
β€ŽI thank ALMIGHTY GOD for giving me the gift of writing.
β€Ž
β€Ž
β€Ž
β€ŽΒ© Adecanwrite

Want your public figure to be the top-listed Public Figure in Lagos?
Click here to claim your Sponsored Listing.

Category

Telephone

Address

Lagos